![]() |
|
|
#1 (permalink) |
|
Registered User
NR Court Judge ![]() ![]() |
One Day for the Robber
By The Koan VERSE 1 Monkey no get job How im go take chop? Ever since I graduate My eye red like ketchup. I no dey sleep, dem no dey wait sey make guyman catch up. I dey for grass hut dem dey build upstair. No fear, hope dey. God dey hear, I go pray. Hin no go gree hin pikin beg bread, no way! See my sister, leg spread because aristo go pay. Dem musto pay! Na me dem dey take play? Anyway game over like Winning Eleven, I don score! I don ready for Heaven I come for war! For money I no reach ya level but gun nko? My bullet pass ya naira Take time, I go open fire if you no enta boat I go blow you for throat God help you if you shout bullet go enta ya mouth You no go see house till ten million enta my account CHORUS Poor man dey hustle Monkey dey cry Baboon dey fly. No ask me why Everyday for oga, one day for the robber VERSE 2 Una no wan hear sey una suppose fear when hungry people plenti and dem dey live near? I be ya neighbour but na when labour dey you dey remember. Where youdey for 25 December? Even when I tar ya road or carry ya load you go do me like olodo give me one hundred make I carry go. I see your car dey go you go splash me. Even to say sorry sef, you go fashi. You carry my wife, like she be ashi just because we dey find chop. But I don make my mind up. Na ontop ya gate you go find us. Ya houseboy na my broda that's why im no go bother to even wake una na so we go take una radio, TV and VCD; We dey do dis tin easily! You no go find out till morning by dat time you go hear sey we absconded for dat kind 3 a.m. Na border we dey men. We don cross Sorry bros We don loss
__________________
"It is necessary to create constraints, in order to invent freely." -Umberto Eco. "What is demanded today is Christianity without the system that has been built around it in the West." -Isaac Delano, "One Church for Nigeria"(1945) Last edited by Sir Koan; 04-18-2007 at 07:34 PM.. |
|
|
|
![]() |
| Bookmarks |
| Currently Active Users Viewing This Thread: 1 (0 members and 1 guests) | |
| Thread Tools | |
| Display Modes | |
|
|