Naija Ryders

Go Back   Naija Ryders > Main > Poetry and Lyrics
Connect with Facebook
Register Blogs FAQ Members List Guitar Hero Calendar Mark Forums Read

Reply
 
LinkBack Thread Tools Display Modes
Old 03-08-2007, 02:40 AM   #1 (permalink)
Stupor Mundi
 
Join Date: Nov 2001
Location: Beyond Good and Evil
Posts: 15,511
Points: 360.45
Bank: 136,201.89
Total Points: 136,562.34
Donate
Rep Power: 73433 Riversboy is a legendRiversboy is a legendRiversboy is a legendRiversboy is a legendRiversboy is a legendRiversboy is a legendRiversboy is a legendRiversboy is a legendRiversboy is a legendRiversboy is a legendRiversboy is a legend
Talking PH football

Me and my palis go
Hotel Aristo
because we know dem go dey show
all di football wey go dey go on
for England and Europe
if you dey find me, make you hope
sey Barcelona no go play
and dat di Gunners no go dey
if not you no go see my face
unless you go di place
where dem dey play dat sweet football
I no go answer if you call
my phone
our business dey postponed
di money wey I loan you
pey am monday
when Champions League no go come dey.

Di club wey I love pass
na Port Harcourt Sharks
but I no fit watch dia match
for telly so I don dey spark
for all di stations
for we nation
dem no fit show our premier league
but dem fit show Serie A league
E dey pain me!
If dem pay me,
me I go tape di match myself
and commentate di match myself.
"Sharks dey hold di ball.
Enyimba goalie fall.
Striker enta box
he tries a shot
a chance for Sharks...
GOAL!"
__________________
RB.

I'm gonna miss this ID, and so are you. Anyway all things change. My new ID is Koan.

Ceterum censeo Al Qaedinem esse delendam.
Riversboy is offline   Reply With Quote
Reply

Bookmarks


Currently Active Users Viewing This Thread: 1 (0 members and 1 guests)
 
Thread Tools
Display Modes

Posting Rules
You may not post new threads
You may not post replies
You may not post attachments
You may not edit your posts

BB code is On
Smilies are On
[IMG] code is On
HTML code is On
Trackbacks are Off
Pingbacks are Off
Refbacks are On

Points Per Thread View: 0
Points Per Thread: 0
Points Per Reply: 0
Forum Jump


All times are GMT +2. The time now is 01:20 AM.


Powered by vBulletin® Version 3.8.3
Copyright ©2000 - 2012, Jelsoft Enterprises Ltd.
Content Relevant URLs by vBSEO 3.2.0
NaijaRyders